Commons: General disclaimer
WIKIMEDIA COMMONS NO DEY GUARANTEE VALIDATY
Nah 'Wikimedia Foundation Inc. wey dey host Wikimedia Commons, and dem register am for Florida Department of State, Division of Corporations with this number N03000005323. Wikimedia Foundation nah foundation wey dey under the law of the US federal state of Florida. The name and the address with the U.S. Copyright Office in Washington D.C. for the designated agent to dey receive notification of claimed infringement for the Wikimedia Foundation is:
- Stephen LaPorte, Designated Agent
- Wikimedia Foundation
- c/o CT Corporation System
- 330 N Brand Blvd
- Glendale, CA 91203-2336
- Phone: +1 (415) 839-6885
- Facsimile number: +1 (415) 882-0495
- Email: legal
wikimedia.org
If you wan ask questions abi you wan interview request, you fit contact the active Wikimedia Commons Contributors for the informal level. See Commons:Contact us.
About Wikimedia Commons
Wikimedia Commons nah online open-content media platform wey anybody or people fit volunteer to use and also use am to put different medias. The structure dey allow anybody wey get phone and data with browser app to fit be able to edit anything wey dey here. Also carry for mind say anything wey you dey see here never dey reviewed by Ọga kpata kpata wey sabi how dem fit use better techniques provide the accurate information.
E no mean say you no go fit find better thing for Wikimedia Commons; Also carry for mind say Wikimedia Commons no dey completely guarantee validity for anything wey you see for here. E fit be say the thing go don change or e fit also be say bad person don change am to another thing wey no concern wetin you want.
Responsibility
No body wey dey for here even the people wey dey write for here wey be say dem dey contribute for this Wikimedia Commons dey responsible for anything wey no dey correct for this platform.
Conditions to use this platform
Abeg make sure say you calm down understand say the information we dey for here nah free, and say no kind of agreement dey between you and anybody for here, the people wey get the server ooo, the individuals ooo, Wikimedia Commons contributors ooo, any project administrators ooo, sysops ooo or anybody else wey dey in any way connected with this project or sister projects subject to your claims against them directly.
Any of the trademarks, service marks, collective marks, design rights, personality rights or similar rights dey mentioned for here, anything wey dem use or cite(link) for this Wikimedia Commons platform nah the property of their ọga kpata kpata owners. As we dey use am for here no mean say you go fit use them for any other thing wey no be for the same informative purpose wey make the ọga kpata kpata owners upload am for Wikimedia Commons under the specified licensing wey dem put. Unless otherwise stated Wikimedia Commons and Wikimedia sites are neither endorsed nor affiliated with any of the holders of any such rights and as such Wikimedia Commons can not grant any rights to use any otherwise protected materials. Your use of any such or similar incorporeal property is at your own risk.
Carry for mind say the information wey you see here fit dey in violation of the laws of any country or any place wey you dey see am. Wikimedia Commons no dey encourage anybody to disobey any law as dem sign am for United States of America and maintained in reference to the protection of United States Constitution's First Amendment and under the principles of the Universal Declaration of Human Rights of the United Nations.
The law for your country fit no recognize the broad protection of free speech as the law of United States or the principles dey do, wey dey under the UN charter and as such, Wikimedia Commons no fit dey responsible for any violations of those laws if you link am to this platform or use any of the information wey dey contained here in anyway whatsoever.
- Wikimedia Commons no be actually peer reviewed; why be say readers fit correct any errors or remove anything, Dem no get the right and power to do so and so, anything wey you see here no dey fully guaranteed to fit anything you wan use am for.
No consequential damages fit be sued against Wikimedia Commons, as e be say nah voluntary association of individuals developed freely to create various open source for online educational, cultural and informational resources. We dey give you this information gratuitously and whole heartedly and no agreement or understanding between you and Wikimedia Commons regarding you using or editing or changing of this informations beyond the Creative Commons Attribution-Sharealike 4.0 International License (CC BY-SA) and the GNU Free Documentation License (or any other license that wey fit apply to individual files); neither anyone at Wikimedia Commons responsible should someone change, edit, modify or remove any information that you post on Wikimedia Commons or any of em brother and sister projects.
Thank you for spending your time to read thing whole thing and to understand am, and enjoy your experience for Wikimedia Commons.